No time for phonΓ©, Na pigin go sure pass. πππ
Baba God, abeg make e no be you like say I dey disturb,
If to say things clear, I for no need wiper o.
I no wan ask why life hard like this because you Don create am be say you Don create am,
And Na here we dey so.
Person dey hustle everyday to make sure say small money go still remain wey we go drop inside kolo after we Don commot even miscellaneous
But now, e be like say Na people like us dem dey do ijebu garri for.
Worry Don kill me still bring me back to life.
No be like this I plan buy Range Rover for my papa and mama o.
Na money wey no dey make me and my girlfriend dey always debate o
Dey say person like me wey dey mole more than 15wraps no be man. (if you know you know)
Baba God, Na up you dey dey watch o,
Na stubborn we stubborn, we no dey rob o
Yes, we know say mad man self dey carry dreadlocks,
But Na decision Na im make all man different.
Sake of say make we no carry metal Na im make us dey burn leaf o,
To dey cool ourself down until you return back from your leave o.
We know say e go bad if we turn bad,
But abeg forgive us if Las Las we decide to Jack bull for horn,
You know say no be like this we take start,
Na the same condition make crayfish bend.
No condition dey permanent,
But this our own con dey be like Hausa man perfume.
Abeg Baba, e no go take you anything to put me where go favor me,
I Don tire to dey feel like one prodigal son.
Na beg I dey beg, I no do Shakara.
Thank you.
#IamPensWorld

No comments:
Post a Comment